Money Street News


Picture of Aduke Gold, wearing purple cloth

Wia dis foto come from, Aduke Gold/ Facebook

University College Hospital (UCH) Ibadan don react to di death of popular gospel singer Aduke Ajayi aka Aduke Gold wey die on Monday.

Na on Tuesday morning, di tori start to flood social media afta fellow musician, Esther Igbekele post about di mata for her Instagram page.

For her caption she write say, “RIP Aduke Gold. A General don fall.”

Dis dey come four months afta anoda gospel artiste, Morenikeji Egbin Orun.

One video bin trend on social media wia one man bin tok say “finally, UCH release Aduke bodi afta several hours of shouting, screaming, dem finally release am”.

Tok-tok pesin for UCH Funmilayo Adetuyibi tell BBC say na dia hospital Aduke Gold die and also chook mouth on di video wey bin trend on social media.

She say di pipo wey dey di video bin dey para say dem no quick write Aduke Gold death certificate.

Adetuyibi say wia Aduke Gold die no dey in care of di doctor wey family bin dey ask for di singer death certificate.

She say na wetin cause delay in writing death certificate, wey make di pipo dey para.

“She bin dey go through diagnosis, na in di process of di diagnosis she die. No be ward or theatre she die. I no fit disclose too deep into her medical record”.

Skip TikTok post

Allow TikTok content?

Dis article contain content wey TikTok provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di TikTok cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites. TikTok content fit contain adverts.

End of TikTok post

Skip Instagram post

Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Reactions dey come from all ova social media as some pipo dey ask wetin dey happun for di Christian ministry like dis wey pipo dey die.

While odas remember di musician for di ogbonge Youba spirituals wey she dey drop like, Nitori Ogo.

Who be Aduke Gold?

Dem born Aduke Ajayi, wey many pipo sabi as Aduke Gold, for 1990 for Ilesha, Osun State.

Aduke Ajayi bin lose both her parents wen she dey four years old.

Wen she first start her music career, pipo bin dey call her Aduke Penkele sake of how slim she dey and look for stage.

Di late Aduke Gold bin get opportunity of free education to go university wen one commissioner for youth affairs and sports for Lagos State at dat time, Opeyemi Bamidele, bin give free education.

And she graduate for Lagos State University wit degree for International Relations.

Late Aduke Gold also study about children, and gbab Diploma award for United Kingdom.

Aduke Gold also learn about pipo wit special needs, di care and breeding of fish, teaching and cake making, apart from di music wey make her popular.

On Monday night, August 12, 2024, Aduke Ajayi bin leave di world.





Source link

Related Articles

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

SUBSCRIBE TO OUR NEWSLETTER

Get our latest downloads and information first. Complete the form below to subscribe to our weekly newsletter.


No, thank you. I do not want.
100% secure your website.